Sitemap
Ajewole Raphael Temitope

Ajewole Raphael Temitope

Animal Scientist. 🦘|| Freelance Writer. ✍️|| Data Analyst📈 || Music Producer. 🎹|| One of God's Limited Edition. ✝️|| Penning out my mind! 📝

ACRIMONY

3 min readMar 1, 2024
Fragments

PS: This story is a fiction and it’s written in English, Pidgin and Yoruba.

Get Ajewole Raphael Temitope’s stories in your inbox

Join Medium for free to get updates from this writer.

This is not a true life story. It's a made up story.

Fragments

I so much love you, I cherish you with my all. The money will come someday and I sure will take good care of you. Na wetin Damilare dey always tell Sandra be that, him girlfriend.
Sandra na Damilare babe, dem don dey together since dem enter university for 100L.
Dem too love each other, My brother dey wait make dem graduate. Damilare no know say na jonzing him dey calculate. Brother never give her babe body hitting Since 100L wey dem don dey relate now they made it to final year and signed out.
Na so NYSC spoil the whole matter. Dem deploy Sandra go Port-Harcourt. She meet another fine Bobo. Na so she call Damilare, tell am say "Oga I no dey do again".
Na so so shout Damilare shout. "Ah! I so much love you, I cherish you with my all. The money go come oneday and I sure will take good care of you." Na the same story wey Damilare dey always tell Sandra be that, him girlfriend.
This time around, he even say "I go buy you Porsche if the money come"
Just give me small time. I go soon make money. My time go soon come.
Na so Sandra shout on am over the phone. She say " Oga Stop! Let the money speak. I don dey with you for plenty years, going to six years. E no gel, I no enjoy you since all these years. Na only mouth you get. I wan rock Fendi too.
I love you die, don’t go. Biko, I go fit die for you. Baby, please money go come. Damilare tell Sandra.
Sandra be like ripe yellow mango. Damilare love her. He dey find am hard to let go. Small time, Sandra Don carry belle for fine the Bobo wey she meet for NYSC camp and the Bobo be oga for First Bank.
On the long run na so the fine Bobo wey Sandra meet for NYSC camp kpai.
Na so the late Bobo family pursue Sandra comot and still no collect the belle.
Damilare Don move on. Damilare wey no get level before don dey ball. Thank God for this new slim lady wey Damilare just meet. Christiana. Thank baba God for Christiana for him life. Na so Christiana go play Damilare song for Glo concert. Na so Adenuga fall in love with him song and Adenuga endorse Damilare. Damilare don go feature Ọmọ Baba Olówó for him song. Small time, Damilare don blow, he don upgrade. Na so Sandra come dey jealous, she Come dey regret. She no fit sleep, na so so cry she dey cry all night. She no know how she go take pay her house rent, plenty bills boku for her neck. Landlord Don dey disturb her. She’s always in deep thoughts, looking for way out, asking herself what’s happening.
Na so she carry her phone, call Damilare explain her matter give am.
Damilare Wan pity her, na so he remember say she Don show am Pepper before.
But brother still nice, still give am something chilling.
Damilare come carry Christiana, him new baby go Italy. Travel round the world, enter Chris Brown show. Buy her latest Porsche with gold waist chain. Give her nice touch inside Mercedes Benz for Dubai.
He make her feel alright, he make her no wan comot. Do the Starboy thing. Ọmọ Ológo. 😎
He tell her say, Assurance dey. Fọkàn balẹ̀.

--

--

Ajewole Raphael Temitope
Ajewole Raphael Temitope

Written by Ajewole Raphael Temitope

Animal Scientist. 🦘|| Freelance Writer. ✍️|| Data Analyst📈 || Music Producer. 🎹|| One of God's Limited Edition. ✝️|| Penning out my mind! 📝