BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Police rescue 10 victims wey gunmen kidnap for Imo State inside buses wey dey go NYSC camps
Di buses bin dey travel to NYSC orientation camps for Imo and neighbouring Akwa Ibom state wen di jaguda pipo attack dem on Thursday morning.
How Nigerian politicians celebrate kontri 66th Independence Anniversary
President Bola Tinubu tok about im economic reforms as im ask Nigerians to dey confident in di kontri future.
FCT Minister Nyesom Wike son say im no collect $2.1m from businessman ova Abuja land deal
One Safwan Garba carry mata go court as e allege say Jordan Wike no fulfil dia agreement for one joinbodi real estate business afta e collect $2.1 million from am.
South Africa anti-migrant group protest against gender-based violence and illegal migration
Di anti-migrant group 'March and March' bin announce 30 September as deadline for undocumented migrants to comot from di kontri.
Africa richest man Dangote open refinery for Kenya – Wetin dis mean for Africa
As di groundbreaking ceremony for di proposed 700,000bpd Dangote Refinery dey hapun for Lamu, Kenya, here na wetin di development mean for di East Africa region.
South Africa President Ramaphosa announce four immediate measures to tackle violence against women
President Cyril Ramaphosa go address di nation dis evening on di steps wey im administration dey take to confront gender-based violence and femicide
Journalist Edward Kijanangoma become new King of Tooro Kingdom afta succession wahala
For long, di new monarch na familiar face for di East African nation, but many pipo no sabi am as heir to di throne, but as a storyteller.
'Three Nigerians killed in four days' - Nigeria govment react to death of citizens for South Africa
Di Nigerian govment dey ask South Africa to act on dis matta and arrest all di pipo wey get hand for dis killings.
Wetin we know about di 60 fresh abduction for Niger and Zamfara states
Dis na di for di latest wave for di series of kidnaps wey armed criminal gangs don carry out dis year.
Special Tori
South Africa issue deadline to end green ID booklet wey go address illegal immigration
South African govment tok say di current green ID booklet dey very easy to forge and e follow for wetin dey cause illegal migration issues for di kontri.
Popular Zimbabwe businessman Wicknell Chivayo die wit im wife and four odas for helicopter crash
Zimbabwe businessman Wicknell Chivayo, togeda wit im wife, Lucy Muteke die for helicopter crash.
'Nigeria don pass through red sea' - Key highlights of Tinubu Independence Day nation address
Tinubu tok say Nigeria don cross di red sea and say im don repair di foundation of di kontri economy, so pipo suppose expect di good times now.
Netanyahu say pilot chop arrest afta e stab co-pilot and try to crash plane wey dey go Israel
Di Flydubai plane wey take off from Dubai International Airport early on Wednesday send emergency code about two hours afta di journey start, according to flight tracking website Flightradar24.
Police arrest commissioner, 5 odas wey allegedly get hand for di beating of deputy director to death for Delta
Police arrest five pesins and launch manhunt for two suspects as dem dey investigate di death of one deputy director of Education for Delta State.
Special court for Edo say make dem kpai convicts by hanging afta Govnor Okpebholo vow to sign death warrants - wat next?
Justice Aigbona Momodu sentence di four suspects to death sake of say dem bin kidnap one woman for di Vegetable Market along Airport Road for Benin City.
Nigerian politician children wey dey contest for elective positions for 2027 election
Among dem na pikin of former presidents, former govnors and former Senate presidents wey dey seek tickets for major political parties.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.













































